Andre Ayew
Andre Ayew, wey Ghana drop from deir team for the Africa Nations Cup wey dey shele dis month becos say in no dey fit, don enta Olympique Marseille team wey go play Sochaux for Sunday, the French Ligue 1 klub don tok.
The Ogbonge winga, wey don play 44 match for Ghana dem, don recova from the injuri wey in get dat time wey dem dey train about 10 days wey pass, the klub bin tok for deir website (www.om.net)
Ayew, wey b 23 years and na foma Ghana player Abedi Pele pikin, bin suppose show for in National team camp lass weekend make the dokto dem wey dey Black Stars check am see wetin dey, but in no show, the guyman jus miss, wey come make Coachi Kwesi Appiah drop am from the playas wey in wan cari go the Nation Cup.
Strika Morgan Amalfitano and defenda Lucas Mendes, wey dem two miss the French Cup win ova Guingamp lass weekend dey okay and fit play for Marseille wey dey numba three for table.
Like Ayew mata, Togo golkipa Kossi Agassa go play for in klub Stade Reims for Sunday even though dem tok say in no go go Africa Nation Cup becos of knee injuri wey dey wori am
Midfielder Odair Fortes, wey widraw from Cape Verde national team becos of injuri don enta the Reims team wey go play Bastia.
The Africa Nations Cup go shele for South Africa and na from Januari 19 e go start.
NICE TRY
Haaaaa, I love dis pijin now. D3 writer do well proper. I go give am 10 over 10. Na excellent bi dat abi?
FT: Ghana 4-2 Tunisia
This site is getting worse every day.