Pidgin English: Asamoah Gyan talk say na Black Stars team fess

Published on: 28 January 2013

Ghana star playa for dis 2013 Afcon, Asamoah Gyan don tok say na sacrifice wey go make Ghana succeed na him hin dey do for field as dey guyman neva score for dis ogbonge tornament.

“I no dey even think am say I neva score for dis Nations cup, but na how to sacrifice for de team bin dey my head,” Naso Gyan tok.

“Na me be de skippo, and na plenti thin I go do for my country as anytime we dey play, na two defendas dey mark me and I no get chance at all dan to make sacrifice for de team.

“Pipu don dey yab me say I dey miss plenti goal for front, but I no dey miss goal as de tin no just easy for me and I promise to score if I fit get de oppotunity,” De guyman yarn.

Na de fess time be dis wey Gyan go carri Ghana go big tornament as de skippo and de guy no far to make history as na only 5 goals e remain for im to meet Abedi Pele wey na him be de Baba as im don score plenti goal for Ghana.

This website uses cookies to ensure you get the best experience on our website.
Learn more