Ghana Soccer | League Sunday | England League | League Fantasy | Spain League | Italy League | Nigeria League | Germany League | Football | Soccer | Ghana Soccernet

Pidgin English: Ghana take Tunisia drink 'garri'

Posted On Monday, 14th January 2013

Solomon Asante blocks Oussama Darragi

Na ‘play-play’ match e be. Ghana and Tunisia dey prepia for Nations Cup, so dem play diasef for inside Abu Dhabi. Everitin hapin for second haf. Ghana coachi, Kwesi Appiah, enta inside dressing room wit hin playas afta fess haf finish. Weda he gbege dem, or he yab dem; de tin work well, well. Ghana comot for second haf wit anoda mind.

Ghana tia Tunisia net 4 tines for second haf, after Tunisia bin dey waya dem 2-kondo, as dem waya Tunisia 4-2 for inside the Sheikh Zayed Sports City stadium for Abu Dhabi.

Issam Jemaa bin don score two goals, before Kwesi Appiah change Ghana style. Ghana playa, John Boye, start de gbege for Tunisia wen he head Mubarak Wakaso freekick inside net.

The goal bin remind many pipu of Emmanuel Agyemang-Badu goal, wen Ghana waya Egypt for anoda ‘play-play‘ match. Na Wakaso bin nasa freekick dat time too.

Wakaso come waya beta penarity, afta Tunisia bin foul Christian Atsu inside box 18. scores come be 2-2.

Asamoah Gyan, na from bench de coachi bring am, come score Ghana numba three goal, bifor Albert Adomah, anoda playa wey come from bench, come score to make scores 4-2.

Ghana (na Black Stars be dia guyname) bin dey play dia las ‘play-play’ match bifor Nations Cup go start on Saturday, and dia coachi, Kwesi Appiah, leave Solomon Asante and Kwadwo Asamoah for de team. Isaac Vorsah bin get one kin muscle pull bifor match start, so de coachi kukuma put John Boye inside.

Stadium bin empty like some Naija politician head, sake of say de pipu wey organise de match say dem dey fear make sontin no hapin. Dem no yarn us wetin for fit hapin sha.

Richmond Boakye Yiadom start de match as Ghana numba 9, and Christian Atsu bin dey support am for back. Kwadwo Asamoah play for lef side of defence. Solomon Asante bin dey show beta skill but de guyman too dey fall. Many pipu dey wonder how hin go do if he come play contri wey get strong playa dem.

Tunisia start de match like say dem dey vex, as dem control midfild and dia wingers dey play fire. Dem come score afta Issam Jemaa waya net, even tho Msakni and Rabiu Mohammed bin jam demsef, fall, yakata, for ground.

Ghana bin dey wait make refree blow wisu, but Darragi carri ball, lob am for Jemaa. Jemaa run pass Boye come score. Tunisia come dey lead 1-0.

Tunisia come dey holo de midfild, and Ghana coachi come kukuma remove rabiu Mohammed, as de guyman no bin dey play well, put Emmanuel Agyemang-Badu instead.

Wen haf time reach, Tunisia dey lead Ghana and many guymen dey wonder how Ghana wan score sef, as na Tunisia bin dey holo de midfild.

As second haf start, Wakaso colet beta pass from Asamoah. Instead make he pass to Yiadom, de bobo shoot over de bar! Yiadom vex well, well.

E no too tay bifor Isaam Jemaa score hin second goal for Tunisia (na him don score goal pass for de contri sef), as Ghana goalie, Kwarasey, no look de shot well, come let am pass hin hand. 2-kondo.

Ghana coachi, Kwesi Appiah, change de game sharp, sharp. Asamoah Gyan enta for Richmond Boakye-Yiadom and na so game come change.,/p>

Many guymen for Ghana don dey tok anyhow, as per, how Ghana fit win Nations Cup, and dis win wey dem get for Tunisia head suppose make all man cool down small.

Ghana go start dia Nations Cup on Sunday, wen dem go play DR Congo for Port5 Elizabeth, inside South Africa.

Source: SuperSport.com

Related Images



READERS COMMENTS

  1. keith from germany says:

    damn this thing is very hard to read.pls write proper english.

  2. Ei Rham says:

    Hahaha. Entertaining to read.

  3. wonderful kwame says:

    Ghana will win only two matches. You guys should pray and hope those friendly games are not counted as the two. I saw Ghana win their first two games. Ungrateful people.

    • Mashood wood issah says:

      Pls everybody can read from yur coment that yu are hiddin behind ghanaian name to coment… Blackstars are vry ready for yur lucky zambia team.. Southafrica is my ghanas second home.. We dey come…

  4. Plain Truth says:

    Wonderful Kwame, Know that you are not God. You can say what you and wish what you want. You don’t have the final word. God has the final word. Remember the saying, MAN PROPOSES BUT GOD DISPOSES.

  5. SNOW DEMON says:

    WONDERFUL KWAME GO FI FUCK ÏM OWN ARSE. TOUR MAMA.





Click Here For All Latest football news.

Live Radio

http://ghanasoccernet.com/new/images/banners/onair.gif 

Live TV

http://ghanasoccernet.com/new/images/banners/onair.gif



RELATED NEWS

LATEST HEADLINES

Free State Stars could snaffle up Amidaus captain Yahaya Mohammed thumbnail

Free State Stars could snaffle up Amidaus captain Yahaya Mohammed

Ghanaian midfielder Yahaya Mohammed is claiming interest from South African club Free State Stars.
Ghana FA bans BA Stars duo one year each for faking injury thumbnail

Ghana FA bans BA Stars duo one year each for faking injury

The Disciplinary Committee of the Ghana FA has banned two players of BA Stars for 12 months for faking injury after an abandoned Division One League match.
Ghana crushed in opener at  African Beach Soccer tournament thumbnail

Ghana crushed in opener at African Beach Soccer tournament

Ghana's Beach Soccer team lost 9-2 to hosts Morocco in a Group A opener at the African Beach Soccer tournament on Wednesday.
Bechem United defender Richard Baffour banned one-year for kicking referee  thumbnail

Bechem United defender Richard Baffour banned one-year for kicking referee

Bechem United defender Richard Baffour has been handed a 12-month ban for kicking a referee in April during a Division One League match.
Ghana FA partners Interpol to fight match-fixing thumbnail

Ghana FA partners Interpol to fight match-fixing

The Ghana Football Association has joined forces with the country branch of Interpol to eradicate match-fixing from the local game.
Addy hopeful of Vitoria Guimaraes' chances in Europa League thumbnail

Addy hopeful of Vitoria Guimaraes' chances in Europa League

Ghana defender David Addy is full of hope of Vitoria Guimaraes’ upcoming campaign in Europe.

LATEST HEADLINES

Categories