Pidgin English: Ghana don enta wahala for Brazil

Published on: 19 December 2013
Pidgin English: Ghana don enta wahala for Brazil
Ghana

Plenty pipu don dey pity Ghana since yesterday for de group wey Fifa carry dem put for ness year world cup as some dey tok say Ghana no go fit escape for de group.

Na group G na hin Ghana dey (oyinbo dey call am group of death) as dem go jam Germany, USA and Portugal for dia group stage wahala.

Dis na de fess time wey Ghana go enta de same trouser with Portugal and naso all guyman dey tok say Real Madrid winga, Cristiano Ronaldo wey helep Portugal kwalify for de world cup go do Ghana bad thing.

Brazil 2014 go be de 3rd time wey Ghana go show dia face for de world cup and walahi, de Black Stars pass de group stage for de Germany 2006 world cup and South Africa 2010.

Na small e remain sef make Ghana be de fess Africa team wey go enta de semifinal for de 2010 world cup, but Liverpool strika, Luis Suarez na im wicked dem for de kwatafinal as de ball wey de guy take hin hand kommot na hin Helep Uruguay kommot Ghana for road.

Ghana coachi, Kwesi Appiah kon dey shake head afta Fifa pipu finish de draw as de man sabee say him group na die, but Oga Appiah tok say Ghana no go carry lass.

''I know say de group wey dem carry us put na fire, but de thing no go burn us becos I get beta playas wey go do de work for me.

''Na fire for fire na hin de world cup go be becos we no dey waka go Brazil go sleep, but we dey go dia to make our fans jolly,”. Naso de coachi yarn plenty amebo pipu wey follow am tok

Ghana go jam USA for dia fess game for de 2014 world cup on June 16 and na for Natal na hin de wahala match go shelle.

This website uses cookies to ensure you get the best experience on our website.
Learn more